Sunday, 9 September 2012

WAEC examination, Aka was asked to complete the following:..

1) He who fights n run away? Aka: e don surrender be dat na, na fear catch am.� 2) A rolling stone? Aka: No fit just dey roll, na person push am.� 3) He who lives in a glass house? Aka: Na rich politician e go be.� 4) A stitch in time? Aka: dey prevent further tear tear.� 5) Birds of d same feather? Aka: Na d same mama born them.� 6) One good turn? Aka: Na correct power steering fit do am.� 7) A bird in hand? Aka: Wetin e wan be again if no be barbeque. Dem plenty for chicken republic.� 8) Half bread is better than? Aka: Puff puff, buns or garri without sugar.� 9) A journey of a thousand miles? Aka: Na d person wahala be dat na, Why e no enter car or aeroplane jeje?� 10) He who laughs last? Aka: Get brain problem. Make dem examine am becos na beginning of madness be dat.� 11) A patient dog? Aka: Na hunger go kill am.� 12) All work and no play? Aka: Na bank job be dat bros.� 13) Once beaten? Aka: Naa revenge go follow b dat.� 14) A fool at forty? Aka: U never see Naija own, ours starts @ 50.� 15) A friend in need? Aka: Na parasite b dat. (16) Slow and steady... Aka: walahi na last u go carry. Abeg, guess wetin dem give Akin dat year....

No comments: